Di presidential candidate for Ghana Freedom Party for di Ghana 2024 presidential election, Akua Donkor don die.
Running mate to di flag bearer, Kwabena Agyekum Kubi, wey pipo sabi well-well as ‘Roman Fada’ confam her death for one radio programme on Tuesday, 29 October.
E say di 72-year-old politician, wey be di founder and leader of Ghana Freedom Party die, as she dey receive treatment for one hospital for di kontri capital, Accra on Monday.
“For some days now, she no well, so we send her go Nsawam Government Hospital on Saturday. But she her health no bin dey improve. On Sunday, dem call me say dem don carry her go Ridge Hospital.
“So, yesterday for afternoon, di family call me and tell me say she no fit make am.” Roman fada wey be her running mate tok.
Tori of her death wey spread on Tuesday morning bin shock many pipo.
Ova di years, Akua Donkor don distinguish herself as correct politician for Ghana wit di bold way she take dey address di needs of grassroots communities.
She don contest for two previous elections, and di electoral body list her as di third candidate on di ballot for di 2024 presidential race, wey dey less dan six weeks away.
Di politician for her presidential campaign bin promise duty-free port services for di clearance of goods, free education, proper wages for farmers, plus oda policies, wey she hope to implement if she win di 2024 elections.
Her running mate tok say di party go meet on Tuesday to discuss di way forward following di death of dia flag bearer.